Tuesday, 16 May 2017
Periwinkle Ontop akamu: See Gobe!!!
Ehen Country Pipo them, one strong mara dey ground oooo.
One woman husband travel go see him friend, nai him friend wife arrange correct banga soup give am with plenty periwinkle and all the assorted them.
When the guy go back house nai him tell him wife say any food she cook make she they always put periwinkle.
One day the woman cook she come forget to do wetin the man tell am and remain small him almost drive her comot from marriage, nai the woman say if na periwinkle go scatter her marriage make she kuku give her husband wetin him want.
Nai the woman cook rice give her husband she put periwinkle, she cook soup, periwinkle, she make akamu she put periwinkle, she even make tea she still load am put...
Abeg the woman do bad? If na you wetin you go do?
Labels:
ENTERTAINMENT
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment